Bbc

Diddy News: Charges against Sean Diddy Combs

A.Lee51 min ago
All you need sabi about di charges agains Sean 'Diddy' Combs
  • Author, Mark Savage
  • Role, Music Tori Pesin
  • Two years ago, rap artiste and businessman Sean "Diddy" Combs bin throw ogbonge 53 year birthday party for im Beverly Hills mansion wey cost $61m.

    Plenti celebs show for di party wey include Jay-Z, Travis Scott, Mary J Blige, Kehlani, Tinashe, Chris Brown and Machine Gun Kelly.

    Di party bin no just dey to celebrate im birthday but also im 30th year for di music industry wia e work as artiste and produce music for pipo like Mariah Carey, Jennifer Lopez and The Notorious B.I.G.

    But for 2024, tins don fall apart.

    For New York case, dem accuse di star of kidnapping, drugging and forcing women to do sexual tins sometimes wit di use of weapons and threats of violence.

    Skip Recommended s and continue reading Recommended s End of Recommended s

    Di same Los Angeles mansion wey im take do im birthday na im police bin raid for March. Di officers seize supplies wey dem say im bin wan use for di orgies wey dem dey call "freak-offs". Di supplies bin include drugs and ova 1,000 bottles of baby oil.

    Oga Combs deny all di charges and plead no guilty on Tuesday, 17 September.

    Di court case dey happun one year afta di musicials bin face lawsuits from plenti women.

    Dis na di allegations wey dey on top oga Combs head.

    Cassandra Ventura wey be singer and model wey dem dey popularly call Cassie bin sign to Mr Combs record label and also date am for ova 10 years.

    But for one civil suit, she accuse di business man say im use im power to arrange "manipulative and coercive romantic and sexual relationship".

    Her lawsuit bin get description of violent abuse wey accuse oga Combs say e bin dey "regularly beat and kick Ms Ventura wey cause black eyes, bruises and blood".

    She also tok about di "freak-offs" say dem be days of sexual performances wey drugs bin dey wia oga Combs go allegedly force women to do and feem am for im pleasure.

    Ms Ventura also accuse di musician of sexual abuse and rape say many of dis incidents bin dey in fromt of im "tremendous loyal network" wey "no wan do anytin wey really make sense" to stop di attack.

    Di lawsuit also accuse oga Combs say im scata US rapper Kid Cudi motor so im no go date her.

    Combs deny di accuse and bring accuse for Ms Ventura say she wan extort am.

    Dem settle di case for amount of money wey dem no tok one day afta dem file am for New York even though oga Combs still claim say e dey innocent.

    November to December 2023: More lawsuits of alleged sexual assault Weeks afta dem settle Cassie lawsuit, oga Combs start to collect accusation of sexual assault wey bin start around 1991 from different women.

    One lawsuit na anonymously the woman take sue oga Combs say im and anoda man force am for nacks.

    For second one, Joi Dickerson-Neal accuse di star say e drug and sexually assault am wen she be college student for 1991. She also claim say e feem di attack and show am to oda pipo witout her permission.

    Di third woman na Liza Gardner wey file to accuse oga Combs and anoda man say dem rape am and her friend, ova 30 years ago, wen she be 16-years-old.

    She accuse oga Combs say days afta di attack e choke am sotay she faint.

    For di lawsuit she tok say oga Combs bin vex bicos e bin dey find her friend as e bin dey fear say, she go tell "di girl e bin dey wit dat time".

    Di lawsuits bin come shortly bifor di New York Adult Survivors Act bin expire. Di Act na law wey allow pipo wey tok say dem suffer sexual abuse make dem file claims even if di statue of limitations don pass.

    Oga Combs deny all di accuse and im tok-tok pesin call di lawsuits, "money grab".

    December 2023: Underage sex claim Anoda woman sue am for December, she claim say oga Combs, former Bad Boy Records president Harve Pierre and anoda man im "sex traffick" and "gang rape" am for 2003 wen she be 17 years.

    For court papers, di woman wey dem call Jane Doe, tok say dem give am plenti drugs and alcohol bifor di attack start. She tok say she bin dey in soo much pain sotay she no fit stand well-well and no even remember how she take reach house.

    To ansa, oga Combs tok say e "no do any of di awful tins wey dey accused" and oga Pierre tok say di "disgusting allegations" na "lie and desperate attempt to get money".

    December 2023: Diddy denial For 6 December , on top all di lawsuits on top im head, oga Combs ansa for Instagram page statement.

    E write say, "ENOUGH IS ENOUGH. For di last couple of weeks, I don siddon quietly dey look pipo wey dey try kill my character, scata my reputation and my legacy.

    "Sick accusations don dey made against me by pipo wey wan make quick money. Make I dey clear, I no do di awful tins wey dey accused. I go fight for my name, my family and ofr di truth."

    February 2024: Grooming accusations Music producer, Rodney Jones Jr wey produce none of di songs ofr di 2023 The Love Album, comot accuse oga Combs sat e bin make unwanted sexual contact and also force am to get prostitute and make am join to do sexual tins wit dem.

    For New York court filings, oga Jones claim say, oga Combs bin "groom" am to nack anoda man say "na normal tin for di music industry".

    Oga Combs lawyer, Shawn Holley call oga Jnes say e be "nothing but a liar" say im claims na "pure fiction" wey fit denied wit "overwhelming, indisputable proof".

    CCTV video wey show oga Combs dey beat Cassie Ventura for di hall of one Los Angeles hotel for 2016 comot.

    Di pictures wey CNN broadcast show one man dey push Ms Ventura for ground and kick am while she dey dia. E later try drag am by her shirt bifor e come throw sometin on am.

    Ms Ventura later post statement of wetin domestic violence do am say, "e break me to pesin wey I bin no tink say I go turn to."

    Model and actress Crystal McKinney accuse oga Combs say im drug am and force am to do oral sex for bathroom of one New York City recording studio for 2003.

    Two dats afta April Lampros go sue oga Combs say im sexually assault am four times from 1995 to 2000.

    Ms Lampros claim say she meet di rapper for 1994 wen she be student for di Fashion Institute for Technology. According to her, dia initial romantic relationship "sharply turn to aggressive, coercive, and abusive relationship based on sex".

    For one time, she claim sat di star force am to take ecstasy and nack im babe dat time.

    July 2024: Combs still claim innocence even as eight lawsuit dey filed Former porn star Adria English claim say she bin dey "groomed into sex trafficking over time" between 2004 and 2009 for oga Combs popular parties.

    Im lawyer, Jonathan Davis ansa say, "e no mata how many lawsuits dey filed, e no go change di fact say oga Combs no sexually assault or sex traffick anybodi."

    Oga Combs no show for one virtual hearing for lawsuit wey one Michigan inmate Derrick Lee Cardello-Smith file against am say di star sexuallt assault am for one party for Detriot for 1997.

    Di no-show make dem issue default judgement say oga Combs go pay oga Cardello-Smith $100m.

    But di rapper lawyers quickly file emergency motion to overturn di ruling.

    One former singer for Diddy girls group project Danity Kane, Dawn Richard file suit against di star.

    Di singer wey later join oga Combs for di band Diddy Dirty Money, accuse di rapper say e assault am many times by touching her bodi, verbally abusing her and over working her.

    Di star bin dey arrested for one Manhattan hotel room afta grand jury indictment.

    Im lawyer say du star bin co-operate wit authorities and tok say na becos of di charges e even move go New York.

    E add say, "dis na wetin inncoent man wey no get anytin to hide dey do and e dey wait to clear im name for court."

    For one appearance for di US District Court for New York, oga Combs bin dey charged wit sex trafficking, racketeering and transportation to engage in prostitution.

    For indictment wey dem unseal for di same time, prosecutors allege say im also do kidnapping forced labour bribery and oda crimes.

    Prosecutors also accuse oga Combs say e record di "freak-offs" and go use am make sure say im victims no tok.

    If di musician dey convicted e fit spend from 15 years to life for prison.

    Oga Combs lawyer, Marc Agnifilo tok say im client dey innocent and di "freak offs" bin dey consensual.

    E ask say, "Na sex trafficking? Not if everibodi wan dey dia".

    Oga Combs plead not guilty to di charges.

    But dem no gree give am bail afta prosecutors say e fit cause "significant risk" to di trial say e don "alreadi try to obstruct goment investigation of di case, as im contact victims and witnesses dey feed dem wit fake narratives of wetin happun".

    Di judge point at di star anger issues and history of substance abuse as why e go dey detained till im trial.

    E say, "my worry na say dis na crime wey dey happun behind close doors."

    Oga comps lawyer appeal di decision say di star fo dey di watch of round di clock security yeam.

    But Judge Andrew L Carter Jr tok say even wit dat oga Combs fit still use employees to take contact witnesses.

    0 Comments
    0