Bbc
Ghana jam Niger for “pride” afta dem fail to qualify for Afcon 2025 tournament in Morocco
A.Kim36 min ago
Ghana jam Niger for "pride" afta dem fail to qualify for Afcon 2025 tournament in Morocco18 minutes wey don pass Di blackstars of Ghana dey play for "pride" as dey face di Mena of Niger for dia final 2025 Afcon qualifier afta dey fail to qualify for di tournament. For di first time in 20 years, Ghana no go play for di Afcon; dis na low blow for di west African kontri wey bin win di competition four times. Coach of di team Otto Addo dey under pressure to resign afta im fail to qualify di team to di Afcon. In 2021 and 2023, di black stars bin comot di Afcon for di group stage without a win, wia dis time dey no qualify at all. Sabi pipo say dis na di end of di road for Otto Addo. But di coach say di game against Niger na one wey dey go carry appease di fans even though im disagree wit wetin di fans dey tok. "Most pipo bin dey judge me by di results wia neva good, but I gat friends and mentors, I don train under Sammer, Jurgen Klopp wia I be assistant coach for Edin Terzic for Dortmund. Dis pipo bin give feedback na dem I go take, no be anybody for some place wia go dey yab," di coach tok for press conference. Di problems of di black stars don become worse afta four more key players don hurt afta di Angola game. Captain Jordan Ayew wey score free kick goal for dat game, togeda wit Fatawu Issahaku, Gideon Mensah and Alidu Seidu all no go play dis game. One statement from di Ghana football association (GFA) bin tok say "Alidu Seidu and Gideon Mensah no dey fit afta di team assessment as dem finish di Angola game." "Jordan Ayew and Fatawu Issahaku also bin hurt for di game. But one MRI scan don show say im get wahala wit im knee," di GFA explain. Di statement bin add say "di blackstars medical team and di Leicester City team doctors don gree say Jordan and Fatawu go return to England on Sunday to begin dia treatment." Already bifor di Angola game, eight senior players wey include Inaki Williams, Antoine Semenyo, Tariq Lamptey, Alexander Djiku bin withdraw sake of injury. For Niger wia dey third on top di group F table, dey go qualify for di Afcon if dey win vs Ghana and Sudan lose to Angola. Di Mena don thrash Sudan 4-0 for dia last group game wia dia coach Badou Zaki tink say dey gat di momentum to beat Ghana. "Dis game na final; we go play our game to win and make history for di fatherland," Badou Zaki tok local media. Bifor di qualifiers don start, Zaki bin tok say "our group na group we fit qualify. Ghana na football kontri wit ogbonge players but e neva be di team wey dem get 5,6 years ago. Even for dia home dey fit lose." Team news Coach Otto Addo don invite three local based players to join di squad afta Jordan and three oda key players hurt for Angola game. Di three na Medeama SC right back Kamaradini Mamudu, Ebenezer Abban wia also be defender from Hearts of oak and Jerry Afriyie wey dey play wit Thought FC. Di three players already bin train wit di rest of di team on Sunday. Management of di blackstars go hope say di local players go step up and deliver afta one local boy Razak Simpson wey be captain for Nations FC play well well for di game vs Angola on Friday. Westham starboy Mohammed Kudus go captain di team for dis game. Di Mena of Niger bin train for di Accra sports stadium ahead of di game, wia dia captain Youssouf Oumarou no go play di game on Monday sake of im get yellow card suspension. Dia goalkeeper Naim Nhour no go play di game sake of im family member don die. But im get pesin wia don dey replace am for di squad - Habiboulaye Hainikoye. One statement for di nigerienne football association page don tok say "we don prepare for dis game wia we go dey hope say di result for Bengazi (game between Sudan and Angola) go favour us." Dey fit maintain dia defense wit Abdel Rahim Alhassane, Abdoulaye Katore and Nasser. Striker Daniel Sosah wey score 2 goals vs Sudan go lead di attack, wit support from Badamasi and Kairou Head-to-head Niger bin dey rank 125th by FIFA Di last time Niger appear for Afcon na 2013 wia dey comot for group stage. Dey go hope say dis time dey fit qualify for di tournament for Morocco in 2025. Between Ghana and Niger, dey don meet each oda 15 times, wit 11 wins for di blackstars and 2 defeats wit 2 draw. Di last time di two teams meet for di African nations championship on 28 January 2023, Niger don win 2-0. Di oda blackstars defeat happun on 29 July 1988 (0-3) for international friendly. Di first draw between dis two teams happun on 17 February 1982 for di west Africa nations cup; dat game end 2-2. Probable lineupsNiger: Hainikoye (GK); Alhassane, Katore, Boueye, Yakubu; Badamassi, Moussa, Diabate; Abraham, Sosah, GoumeyGhana: Joojo Wollacot (GK); Razak Simpson, Ebenezer Abban, Mamudu Kamadini, Elisha Owusu, Ebenezer Annan, Abu Francis, Mohammed Kudus, Ernest Nuamah, Ibrahim Sulemana, Emmanuel Antwi Dis game go happun at 4 PM GMT and 5 PM WAT We go bring you live commentary for dis game as Niger look to qualify for di Afcon for di first time since 2013.
Read the full article:https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2063nxwlqxo
0 Comments
0