Bbc

Mossad: Wetin be di wins and failures of Israel spy agency?

J.Nelson23 min ago
Mossad: Wetin be di wins and failures of Israel spy agency?
  • Author, Staff reporters
  • Role, BBC News Arabic
  • For one surprise move, pagers plus oda communication devices wey Hezbollah members bin dey use transform into mobile explosive devices.

    Dis devices wey dem bin dey use wit mind say dem go fit dodge Israel advance surveillance, blow for di hands of dia users, killing dozens of pipo plus injure thousands of odas.

    Lebanon goment accuse Israel of di attacks, dem call am "criminal Israeli aggression," while Hezbollah promise "fair retribution."

    Israel never respond to di allegations, but some Israeli media dey report say im cabinet don give ministers instruction make dem no make any public statements about di event.

    Typically, Israel dey monitor Hezbollah activities closely, dis na suggestion say di operation fit be part of di conflict wey dey occur between di two sides.

    If Israel dey responsible, dis one go rank among im most surprising and impactful operations, reviving memories of past missions wey bin dey attributed to Israel, and im national intelligence agency, Mossad, in particular.

    Mossad successful operations Mossad don collect accolade for many successful operations. Dis na some of di popular ones.

    Hunting down Nazi officer Adolf Eichmann Di 1960 abduction of Nazi officer Adolf Eichmann from Argentina na one of Mossad most popular intelligence successes.

    Eichmann bin be key architect of di Holocaust, wia Nazi Germany murder some six million Jews for World War II.

    Afta im escape capture by moving between many different kontris, Eichmann eventually settle for Argentina.

    One team of 14 Mossad agents track am down, kidnap am, carry am go Israel, wia dem try am and ultimately dem execute am.

    Operation EntebbeOperation Entebbe for Uganda for 1976 dey dey regarded as one of Israel most successful military missions.

    Mossad provide intelligence, while Israeli military carry out di operation.

    Two members of di Popular Front for di Liberation of Palestine and two German accomplices bin hijack one plane wey bin suppose fly go Paris, divert am go Uganda. Dem bin hold passengers and crew hostage for Entebbe airport.

    Israeli commandos blow like thunder enta di airport, rescue di remaining 100 Israeli and Jewish hostages.

    Three hostages, the hijackers, several Uganda soldiers, and di lead commando Yonatan Netanyahu (brother of Israel current Prime Minister, Benjamin Netanyahu) die for di raid.

    Operation Brothers For one act of deception, for early 1980s, Mossad – acting on instructions from Prime Minister Menachem Begin – smuggle more dan 7,000 Ethiopian Jews go Israel through Sudan, using fake diving resort as cover.

    Sudan bin be enemy Arab League kontri, so operating codedly, one team of Mossad agents set up one resort for Sudan Red Sea coast, wey dem bin use as dia base.

    By day, dem masquerade as hotel staff and by night, dem smuggle Jews, wey bin secretly trek from neighbouring Ethiopia, out of di kontri by air and sea.

    Dem bin run dis operation for at least five years, and by di time wey dem discover wetin dey happun, di Mossad agents don escape.

    Revenge afta Munich Olympics killings For 1972, Palestine militant group Black September kill two members of Israel Olympic team for di Munich Olympics plus capture nine odas.

    Dem later kill di athletes for one failed rescue attempt by West German police.

    For di years wey follow, Mossad target di pipo wey dem suspect say get hand for di attack, including Mahmoud Hamshari.

    Dem kill am am wit one explosive device wey dem bin plant inside di phone wey bin dey im Paris apartment.

    Hamshari lost one leg for di explosion and ultimately die from im injuries.

    Yahya Ayyash and di exploding phone For one similar operation for 1996, dem bin assassinate Yahya Ayyash, wey be key bombmaker for Hamas, by filling one Motorola Alpha mobile phone wit 50 grams of explosives.

    Ayyash, wey bin be prominent leader for Hamas military wing, bin popular as expert wey dey construct bombs and organise complicated attacks against Israeli targets.

    Dis one make am di main focus for Israeli security agencies as one of Israel most wanted men.

    For late 2019, Israel lifte censorship onsome of di details of di assassination, and Israel Channel 13 TV broadcast one recording of Ayyash final phone call wit im father.

    Di assassinations of both Hamshari and Ayyash highlight one long and complicated history of using advanced technology for target killings.

    Mahmoud al-Mabhouh: Strangled to death For 2010, dem bin assassinate Mahmoud al-Mabhouh, senior military leader for Hamas, for one Dubai hotel.

    Initially, e bin look like say na natural death, but Dubai police bin eventually fit identify di assassination team afta dem examine surveillance footage.

    Police later reveal say na kill dem kill al-Mabhouh by electric shock and den strangle am.

    Di operation wey dem suspect say na Mossad plan am bin cause diplomatic anger from United Arab Emirates.

    Israeli diplomats, however, claim say e no get any evidence wey link Mossad to di attack.

    However, dem no deny say dem no get hand inside, wey dey in line wit Israel policy of maintaining "ambiguity" on dis kain mata.

    Assassination attempts wey fail Even though em get many successful operations, Mossad bin also get well known failures.

    Hamas political leader Khaled Meshal For one operation wey lead to one major diplomatic crisis, na Israel 1997 attempt to assassinate Khaled Meshaal, head of Hamas political bureau, for Jordan using poison.

    Di mission fail wen dem capture di Israeli agents, forcing Israel to supply di antidote to save Meshaal life.

    Di den head of Mossad, Danny Yatom, fly go Jordan to treat Meshaal.

    Di incident significantly injure di relationship between Israel and Jordan, wey not too long ago sign one peace treaty.

    Hamas leader Mahmoud al-Zahar For 2003, Israel conduct one airstrike wey target di house of Hamas leader Mahmoud al-Zahar for Gaza City.

    Although al-Zahar survive di attack, e result in di death of im wife and son, Khaled, plus several odas.

    Di bombing completely destroy im house, showing di serious consequence of military operations for area wit heavy populations.

    Di Lavon affair For 1954, Egyptian authorities scata one Israeli espionage operation wey dem sabi as Operation Susannah.

    Di plan bin be to plant bombs for US and British facilities for Egypt to pressure UK to maintain im forces wey dem station for di Suez Canal.

    Dem later sabi dis incident as di Lavon Affair, named afta Israel Defence Minister dat time, Pinhas Lavon.

    Di believe be say im bin get hand for di planning of di operation.

    Yom Kippur War Soviet Union na im bin provide supplies give Syria and Egypt, and di US provide emergency supply line for Israel.

    Israel bin fit repel forces and di war end on 25 October – four days afta one United Nations resolution call for end to di fighting.

    Almost 50 years later, Israel suffer surprise sudden attack again, dis time na Hamas launch am on Israeli towns near Gaza border on 7 October 2023.

    Mossad failure to predict di attack dey considered as major flop, reflecting, according to analysts, one weakness for Israel deterrence policy towards Hamas.

    Di 7 October attack result in di killing of about 1,200 pipo, mostly civilians, Israeli authorities say.

    Some 251 odas bin dey captured as hostages wey dem carry go inside Gaza.

    In response to Hamas assault, Israel start war on di Gaza Strip, wey so far don result in di 40,000 deaths, majority of dem na civilians, according to Gaza

    0 Comments
    0