Bbc

October 1 protest: Who dey ginger and why?

E.Wright22 min ago
October 1 protest: Who dey ginger and why?
  • Author, Kareemot Salami
  • Role, Journalist, BBC News Pidgin
  • As Nigeria dey gear up to celebrate im 64th independence anniversary on Tuesday 1 October, some human rights groups also dey plan to hold protest across di kontri.

    Di ami of di protest wey organisers say go dey peaceful na to end bad governance and di hardship wey Nigerians dey face.

    Nigeria dey experience im worst economic crisis ever, wey dey show in di rise in food prices and petrol hike too.

    One recent survey wey di kontri Central Bank of Nigeria, CBN, conduct from July 22 to 26, 2024 show say di rising inflation rate go force Nigerian households to spend di largest amounts of dia earnings on food for di next six months.

    Dis na as di most recent report by di National Bureau of Statistics (NBS) put di inflation rate at 33.40 per cent, and food inflation at over 40 per cent.

    Who be di organisers of di protest? E no dey clear how many dem be but, one of di major voices for di protest na Omoyele Sowore wey be a former presidential candidate and activist.

    E post for im social media handle say "No going back" on dia plans.

    Sowore wey be di convener of Take it back movement, say oda groups don announce dia interest, and odas go still announce dia interest for di protest.

    Meanwhile, di tok-tok pesin for di Lagos state police command Benjamin Hundeyin tok for im X account say di Commissioner of Police, Lagos State Command, CP Olanrewaju Ishola bin meet with a group of pipo for Lagos who say dem be organisers of di October 1 protest.

    Police say arrangements don dey ground to provide maximum security to di protesters and oda Lagos residents.

    Why dem dey protest? Di reason why we dey go back na to enforce di 15 demands and make sure say we protect di dignity of di pipo of dis kontri". Sowore tok.

    "I sabi say di protest for August bin get 15 demands, non of dem dey met. And afta di protest bin end, di goment arrest, detain and charge some protesters for treason, some still dey detention across di kontri.

    We also sabi say for di economic side of tins, di price of goods and services don go up again sake of say goment decide to increase di price of petrol.

    We dey effectively suspend dia own independence day in favour of our new request for Independence". Sowore tok.

    Skip Twitter post Allow Twitter content? Dis contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites. End of Twitter post

    Wetin happun di last time protests happun for Nigeria? On 1 August 2024, protesters bin hit di streets across Nigeria to demand for end to bad govment.

    Even though di protest no take di dimension wey organisers of di event want, some pipo still feel say dem bin send message to goment about how tins be for Nigerians for di moment.

    For ten days, (August 1-10) organisers under di Take it back movement wit #EndBadGovernanceInNigeria bin call for days of street protest to draw goment attention to di sufferings of Nigerians.

    Di protesters voice dia anger against high cost of living; make goment reverse di removal of petrol subsidy, end corruption and bad governance wey don affect millions for Africa most populous kontri.

    In total, di protesters bin get 15 demands, according to di Take it back group convener, Omoyele Sowore.

    Three days afta di August protest start, President Bola Tinubu bin address di nation wia e call for protesters to suspend dia demonstrations and create room for tok-tok but protesters say im speech no address dia demand.

    Di protest bin initially affect business activities across di kontri, Banks motor parks, shops, malls, markets and roads bin dey empty.

    But as days waka, many pipo bin return to dia normal activities sake of say goments for Lagos and odas bin don approach di court of law to seek injunction wey go limit places wey protesters fit gather for dia demonstration.

    Like many oda protests wey don happun for di past, di August protest no too end well.

    Dis na sake of reports death, kasala wey di flying of Russia flags cause for di north, plus di looting of goment and private property.

    Hundreds of pipo later chop arrests sake of di protest and authorities later charge some of dem to court on offence of treason. – some of dem still dey detention.

    Wetin don change since di 1 August #EndBadGovernance protest? Even though di federal govment don make some economic policies since di August protest, Nigerians still never begin feel di impact of the announcements.

    For September, di Nigerian National Petroleum Company Limited, NNPC Ltd release wetin dem say be di estimated pump price of petrol across Nigeria based on September 2024 pricing from di Dangote refinery.

    Nigeria annual inflation dey di highest inside almost three decades.

    Food prices too don go so high dan past years - for example, for Lagos wey be di commercial capital of Nigeria, yams dey almost four times more expensive dan for 2023, while live stock price don increase pass three times of 2023 price currently.

    0 Comments
    0